
Wia dis foto come from, Ecole Supérieure Polytechnique Dakar
Di Doctor Car robot
As Africa don pass more than one million confam Covid-19 cases, innovators on di continent don respond to palava wey di pandemic carry come wit different-different solutions. We bend down select 10 of dem.
Students from di Dakar Polytechnic School for Senegal don build multifunctional robot wey fit reduce di risk of Covid-19 contamination of patients and of those wey dey treat pipo. Di device get cameras and dem fit control am wit app. The designers say e fit move…